Thursday 30 April 2020
Nigerian man wetin for jail sentence after him pour spit for policewoman eye for England
One Nigerian man wey dey England don dey get police wahala wey fit make am go prison as him spit blood for the police officer eye wey one arrest am. The name of the Nigerian man na Temisan Oritsejafor, 41 years old. The Police pipo them come after him neighbour don complain say him dey harass am.
Before this one court hear say then Nigerian man dey on bail as him don arrest another police officer before.
According to the tori wey dey ground now, the Police pipo dem receive call say make dem come flat wey dey Wyken, Coventry on Saturday April 18th after the Nigerian man don harass him neighbour wey him name na Alison Osborne. During the time wey dem one arrest am, dem face small wahala with am wey make am come get wound for nose but as di police dem carry am dey go, him come spit vex spit blood for one of the police pipo dem face wey de name of the officer na PC Napier.
Judge Andrew Lockhart QC na de name of de Judge wey sit down on top Temisan Oritsejafor mata. The Judge say him go charge am with two harassment wey him give emergency workers. One wey him do when him dey on bail and this one wey him do now.
The officer wey arrest am say him dey drag with am wey make am put am down for floor with power. During that process, de Nigerian man come get wound for face and when him female partner come join hand to help am, na dat time Temisan Oritsejafor come see space take spit blood for him partner face. The spit and blood come enter for her eye.
After, them play de camera wey dey de building when dem dey try arrest the man, dem see say the partner dey shake and she no happi at all for the mata. Them no release Temisan Oritsejafor until after them sentence am, we go come know him fate.
Labels:
Home
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment