Police pipo wey dem send go that area later arrest some suspect wey won organised the program to honor their lost member. Police no gree make those pipo carry out the candle light procession even though the pipo say those pipo no commit the crime wey dem kill dem for, say na mata of wrong identification.
The youth for that area no dey happy. Dem come out come express their mind so that pipo go know say as police pipo dem come stop their program wey dem one use take give their friends wey die final respect no good especially wey e be say them kill dem for waiting them no do. Them come talk say this one wey police do na abuse for their right to gather say e no dey proper and e no follow for constitution as dem get the right to gather.
The information about this gathering reach police hand after residents them don complain say the gang wey them dey call "One million boys" wey dey cause wahala up and down for Lagos one gather for that area take give their final respect for their member wey die. Some pipo wey dey live for the area don run go another place until "One million boys" gang don finish with their gathering base on to say dem dey fear for wetin go happen as the mata fit come change from peaceful gathering to plenty problem wey go turn fighting, stealing and destruction of property for the area.
The CDAs wey dey the area go meet police to come secure their area. Police dem come arrange dem self come go the area come put an end to the event of those boys wey dem dey call One million boys.
Those boys wey dem kill be residents for that area but before dem discover, pipo wey dey live for the area together with vigilante pipo think say dem be member of those one million boys, so dem cut their head come throway am for inside canal. Report wey dey be say one of those boys wey dem kill be brother to the Oba of Ikotun. But as at now, dem never discover whether those boys wey dem kill truly be member of the One Million Boys gang.
No comments:
Post a Comment