Saturday, 25 April 2020

Information wey perseon wey wan help injured person need

Information wey perseon wey wan help injured person need

The law wey dey guide people them dey different from other countries and depending on where you dey go determine how you go take do. This law dey help make pipo them live well and do their work well, so that every body go dey ok but e dey important make you know say some countries no wan no say u dey help person, so if you do go pass yourself, you go face the wahala wey dey inside.


As person wey won help person wey dey injured, you suppose don go learn the work well before you even think am say you wan go help. Before you go start, you suppose allow the person wey you wan help no say you dey there, make him give you go ahead before you even begin, no matter how the person take dey injured reach so wahala no go dey at the end. You fit tap am for body, ask am him name, ask am whether him need help before you begin.

The question na, who be person wey won help injured person?


The answer to the question wey dey up na "person wey no want make the injured person die. Him want make the person body heal sharp sharp. Him want make the person no fear, say everthing dey alright. Him no want make the injury wey the person get lead to the one wey go pass person hand", that na why him gatz to render the help shaperly before story go come change or tori go come enter the mata join.

Person wey wan help person as oyinbo them take dey call am na "First Aider", First Aider na person wey don go collect training on top the mata, write exam join, both practical and written and sat the end come pass am. As him pass am, them say make him carry go but when him dey do the work, make him no leave the injured person at all for any reason. Him go dey there with the person, untill person wey pass am go show come collect the mata from him hand.

Person wey pass am fit be doctor or those people wey they carry hospital motor dey make noise when them they waka for road with too much speed. Him need to check and make sure say the place wey the injured person dey, dey safe for am to enter before him go go there go help treat the person. If the place no dey safe, make him no enter cause him go dey useless to himself and the injured person if him enter come join the problem wey dey ground before him enter.

No comments:

Post a Comment