Saturday, 25 April 2020

WHO don make Okonjo Iweala special envoy on top COVID-19 mata

WHO that is World Health Organisation don name Ngozi Okonjo-Iweala wey be Nigeria former minister on top moni mata as special person wey go dey show face, she go waka go represent WHO for the new inaugurated Access to COVID-19 tools (ACT) accelerator.


Tedros Ghebreyesus, W.H.O director general make this annoucement of the new post wey them give Okonjo-Iweala for program wey them open for ACT Accelerator through webinar from Geneva.

She and Andrew Witty, the owner of GlaxoSmithKline go dey work together on the same level.

Before this one happen, Okonjo Iweala don first get one job for South African as member of the Country's economic adviser council. Na them dey give advise to the president and government on how to create things wey go make the country good. This one happen for March 7 2020.

later for April 10, she come land enter another one. This one, the managing director of the International Monetary Fund (IMF) name Okonjo Iweala as member of the fund's external advisory group. Na them go serve as pipo from othe part of the world wey go serve as Georgieva's special advisers.

As she still dey do this, she enter another one, but this time na for WHO. WHO say Ngozi Okonjo-Iweala go be special envoy for the newly inaugurated Access to COVID-19 tools (ACT) accelerator.

Ngozi Okonjo-Iweala dey among the four special envoys wey them African Union (AU) give the work on April 12, say make them mobilize international support for the thing wey them try toward making pipo them know about coronavirus pandemic. Them say, those special envoy go dey reponsible with soliciting the support of the G20, the European Union and other outside moni school for the organiations response.

E go good make you also remember say Ngozi Okonjo-Iweala na economist and development guru, wey don work as managing director of World Bank.

No comments:

Post a Comment