One hospital wey dey for Lekki Phase 1, Lagos don get two COVID-19 case. The name of the hospital na Vedic Lifecare and the two case na workers wey dey work for the hospital.
The oga them wey dey the hospital talk say their worker wey get the virus get catch am after them treat customer wey get am and him result no come out on time before them know.
The oga them wey dey the hospital say them don close the hospital for decontamination and their worker wey don catch the virus don dey isolation centre wey Nigeria Centre for Disease Control (NCDC) dey manage.
According to the oga them wey dey the hospital, them say
"Dear customers and visitors. Approximately 10 days ago, we had an in-patient who later tested positive for COVID 19 after discharge. As per protocols set by NCDC we have tested our staff who have come in contact with the COVID positive patient and unfortunately, we have had 2 staff members who tested positive yesterday,” it said.
“The patient and our staff are now being managed by the NCDC at their isolation center. Till this moment they do not show any symptoms. As per the government COVlD-19 management protocol the facility is currently closed off for decontamination of the building and the fumigation activities"
Them say 10 days ago, one customer wey no well come for treatment for the hospital, the result show say him get the virus after them say make him go house. Them want make una no say them don test all their workers wey see or attend to the sick customer and the bad thing wey follow be say two of their worker come follow catch the virus.
Their worker and the sick person don dey for where government dey treat them and as at now their worker body still dey ok as them no show sign wey pipo wey get the virus dey show for body wey go make you know say them no well. The hospital dey close now as government dey work on am in order to decontaminate the hospital area.
Clockwisenews is evolving.....
No comments:
Post a Comment