Tuesday, 21 April 2020

17 Hospital for Lagos wey dey close on to COVID-19 mata

The tori wey dey this section today na say, 17 hospitals wey dey for Lagos State wey dey for Nigeria don follow dey exposed to this COVID-19 mata.

Professor Akin Abayomi wey be Commissioner for Health for Lagos State come out say na 17 Hospital e affect for the state.


The Professor say, the pipo wey dey on top for health mata for the state with one agencies Health Facility Monitoring and Accreditation Agency (HEFEMAA) follow help dey clean the clinic so that the virus wey dey there go die and as dem dey do the work, Government don tell the other clinic wey the virus mata affect to close. They say make them no take any sick person again until them finish the work for the clinic.

Professor Abayomi also make us know say the way wey them take they test pipo for this COVID-19 mata don increase. Him say them dey do reach 200 in a sharp speed, say before them finish work for that day them dey check pipo reach 1000

According to the commissioner, him talk say

THEY HAVE TO GO THROUGH A PROCESS OF INFECTION PREVENTION AND CONTROL TRAINING OF ALL THEIR STAFF AND IF THEY GO THROUGH THE HEFAMAA CERTIFICATION, THEY WILL RECEIVE GUIDELINES ON HOW TO MANAGE COVID-19 PATIENTS IN THE FUTURE SHOULD THE CASE ARISE WHERE GOVERNMENT WILL PARTNER WITH PRIVATE SECTOR TO MANAGE COVID-19.

“THIS SCENARIO MAY PRESENT ITSELF IF WE BEGIN TO SEE VERY LARGE NUMBERS OF CASES ON A DAY-TO-DAY BASIS AND THE LAGOS STATE FACILITY MAY BE OVERWHELMED.”

This na the list of the name of the hospitals wey dey affected wey we get for now:
1. St Edwards Hospital, Ajah
2. Premier Specialist, VI
3. Vedic Lifecare, Lekki
4. The Point Hospital, Surulere
5. Chosen Church Hospital, Ijesha
6. Ikorodu General Hospital, Ikorodu
7. Alimosho General Hospital
8. Ultra Care Hospital, VI
9. St Nicholas Hospital, Lagos Island
10. Reddington Hospital, Lekki
11. Southern Shore Hospital, Chevron-Lekki
12. Paelon Memorial, Ikeja
13. Choice Opticals
14. First Cardiology Consultants, Ikoyi
15. County Hospitals, Ogba

16. First line hospitals, 2nd avenue, by Agboju, festac

The state commissioner for health wey dey Lagos, Professor Abayomi, come talk say two(2) people wey no well before on top the corona mata come die. This na talk wey him talk on 21 April.

The commissioner talk say the first person na 45 year old man wey come back from Indian for month of January.
The second person na 36 year old Nigerian female wey get plenty problem for him body before the virus come join add the former one. The total number of pipo now na 16 wey don die for the virus mata.

This na post wey him put for him twitter account



No comments:

Post a Comment