Wednesday 29 April 2020

Plenty reasons why pipo wey dey smoke suppose stop to dey smoke.

Smoking tobacco no dey good for our body. Plenty things wey e dey do wey pipo wey dey smoke suppose know wey dem no no nah say smoking dey cause:

  • Smokers dey get erectile dysfunction
    Erectile dysfunction na wetin pipo wey go school talk say be when man prick stand, e no dey tey before e sleep. If you call am back, e no go tey again, e go sleep. This na one problem wey smoking dey cause for man body. So if you be man wey no won get this kind problem for body, make you kuku stop to dey smoke now wey e never late.
  • Ectopic Pregnancy
    11% of women wey dey get this one, na smoke wey dem dey smoke dey cause am. Ectopic pregnancy, na when the egg wey dey carry the pikin dey grow for wrong place for inside the woman body. Most times e dey grow outside the main place wey e suppose grow.
  • Their life span dey reduce small small
    Pipo wey dey smoke dey short their life span with 10 years less the normal time wey dem suppose live for this earth. So if you dey smoke, e better make you stop the smoking so that you go live long. 
  • Smokers get high rate to catch lung cancer
    Na smoke wey person dey smoke dey cause that sickness wey them dey call lung cancer for person body. 
  • Smokers get high rate to catch tuberculosis
    This na serious sickness wey dey attack plenty place for person body but most times, na the lungs e dey attack and person wey no get am fit get am from person wey get. So if you dey around person wey get am, make you protect your self and make that person go treat him self.
  • Smokers get high rate for diabetes
    Smoking follow get hand for diabetes wey them dey call type 2.
  • Secondhand smoke
    You no dey smoke, but you dey dey inside room or area wey pipo wey dey smoke plenty. But you no know say you dey smoke the one wey them leave for air for you. E no good for your body because pipo wey do research say if 42000 pipo them wey die of heart disease mata on top the smoke wey them dey smoke. 3400 pipo them wey die out of that number na pipo wey dey take secondhand smoke. Secondhand smoke can also cause a lot harm to members of your family should in case you smoke around them.
  • Sudden Infant Death Syndrome
    Sudden infant death syndrome na when baby wey dem just born just die like that. The chemical wey dey cause cancer for secondhand smoking dey affect this new born pikin them as e dey cause problem for their lungs, heart and brain
  • Bladder, Liver or cervical Cancer
    Smoke wey person dey smoke dey follow cause cancer for bladder, liver or cervical area of the body. So in other make we avoid this kind thing, e better make you stop to dey smoke. 
  • Their bodi no dey respond to cancer treatment/normal treatment
    Smoking usually dey slow treatment down, as e dey weaken de antibodies and cells wey dey help de bodi fight against any foreign object wey won cause wahala for inside the body. The chances of the person to survive treatment especially the one wey gatz to do with cancer fit no work because of the smoke wey de person dey smoke don spoil plenty thing inside the body.
  • Smokers no dey get better Sleep
    Better sleep no dey follow for person wey dey smoke agenda. That is him no dey go far for de sleep wey him dey sleep. Anything wey pass or make noise, him go wake up.
  • Smokers fit loose their vision
    Pipo wey dey go school don do research wey show say smoking dey also make person to dey loose him sight small small till him no go fit use am see again. This na because smoking dey go cause problem for wetin pipo wey go school  dey cataracts and glaucoma wey go come spoil him sight.
  • High rate for life Insurance
    Pipo wey no dey smoke dey get 20% to 30% life insurance rates compared to pipo wey be smokers.
  • Them no dey get youthful appearanceSmoking makes the skin of the person to be looking older than it should be and sometimes, e dey discolor the person fingernails and teeth.
  • Smokers dey get slow rate wounds to healSmoking no dey gree make person wounds dey heal quick. The reason na say e dey reduce the flow of blood to the skin. Research don show say their bones no dey strong, any small thing wey jamb am, na break e go break.
  • Smoking dey reduce sperm
    Smoking dey kill sperm for man body. E dey make the sperm them no dey fit enter inside egg and as them no fit enter inside egg, pikin no go come.
  • Smoking dey cause heart diseaseResearch don show say 1 person out of 5 pipo wey die on top heart problem, na smoking dey cause am.
  • Smoking dey cause strokePerson wey dey smoke, their blood dey dey strong. When e strong too much, e fit cause blockage for some place wey go no go make blood to go up to the brain. When this kind thing happen, na stroke go come catch the person.
  • Smoking no dey let people to save The amount of money spent on smoking can actually help to do better things if the person stop to dey smoke. People wey dey smoke especially the one wey their own to much. Them dey use any moni wey enter their hand take buy ciga.




No comments:

Post a Comment