Monday, 27 April 2020

Over 100,000 pipo recover from COVID-19

The good news wey we dey hear from spain be say over 100,000 pipo them don recover from COVID-19 wahala for their body. This na talk wey the pipo wey dey in charge of health mata for Spain talk for news make we hear.

According to the number wey Spanish Ministry for Health give, them say the number of pipo wey come dey ok na 100,875. This number, na pipo wey them check their body come see say them dey negative before them clear them say make them go. This na better improvement wey happen for the country over the last 24hrs wey the number before na 2,144 pipo.


The number of pipo wey no make am on top coronavirus mata na 23,521 pipo. The new case wey come-come out on top the virus mata na 1,831; so if we join am join the formal number, e go give us total number of 209,465 wey the virus just dey their body. 

The number of pipo wey dey catch the virus now don dey below one per cent and that na good thing for the country.

For sunday wey just pass, Madrid regional government make annoucement make pipo no say as the rate wey pipo them take dey catch the virus dey fall, then one of the hospitals wey dem create  for field go likely close for May 1 wey dey come for front. 

The hospital wey dey for field na the one wey them open for 22nd of March wey dey for IFEMA Exhibition Centre and e get bed wey fit carry 5,500.

No comments:

Post a Comment