Monday 27 April 2020

How to over power fear wey dey our body (pidgin)

Fear na one thing wey get too much power for inside our body wey no go make the person dey ok for that moment wey the fear dey catch am. Fear get powerful effect for person body and na that fear wey dey, go make di person no wetin to do when trouble don plenty for where him dey. For example, fear fit spoil plenty things for you especially, if di fear come catch you for exam hall, or when you get interview for job wey you don dey ready for for a long time.


Fear no suppose dey stay long for inside person body, na for small time after which, di person go come get him self but e get some pipo wey di fear go dey with the dem for life. This kind one no dey good at all as e dey affect when the person dey talk, eat, sleep, travel, drink and plenty other things wey I no mention for here. This kind fear no dey dey good as e dey limit the person from doing plenty things.
Wetin dey make person fear?

Plenty things dey wey be say if person dey fear am, you go dey ok. Some times the fear wey you dey fear na make you no fail so you go come do better pass as you suppose dey do am before and di way wey you go take respond to am go now depend on some kind things like where you take grow, wetin you don pass through for life, how you take cope with them. If you come dey aware of wetin dey make you fear, e go go a long way to help you solve the problem so you no go dey fear again.

How person dey feel when him dey fear

When person dey fear, him body go dey do like this


  • Your heart go dey too fast
  • Your breathing go dey fast
  • Power no go dey your muscle
  • You go dey sweat too much
  • Your stomach go dey misbehave for inside am
  • You no go fit put mind for one place
  • Your eye go dey turn you
  • You no go feel hungry
  • Your mouth go dey dry
  • Your muscles go dey shake

All this na wetin fear dey cause for person body. The bodi go don dey ready to run should incase di mata reach like that. If fear too much for inside person bodi, e fit reach the level wey di person go need see doctor. This na the one wey doctor them dey call mental health problem. so if your fear don dey too much for your body wey e be say you no fit do any other thing, then you need go see doctor.

Wetin you need do so that you go stop to dey fear

Face that thing wey dey make you fear all the time
If you dey always run from certain things wey dey make you fear and e come reach the level wey be say you dey avoid am, that one no go help you because one of the way to stop am na make you face am face to face so you go fit dey free from the fear.

You need no who you be
You need know more about wetin dey make you fear. You fit start to dey write am out, the time wey e happen, wetin dey make am happen and wetin happen. If you start to dey do like this, you fit even set targets wey you go fit achieve for yourself. In other to do this, you go carry the things wey you write take track the time wey you go dey likely to be afraid.

Make you do exercise
Exercise dey help bring out some chemicals wey dey help make our brain dey work well well. So e good as exercise fit help you to dey dey focus and when you focus, you fit forget about the fear for somewhere

Relax
You need to learn how to dey meditate. Relaxation get techniques and that technique go help with mental and physical feelings of fear. One example for this meditation na yoga

You need eat better food
When you eat better food wey get vegetables and fruits, e go help you to overcome the fear. You need eat less sugar, try make you no dey drink tea or coffee. The caffeine wey dey inside am no good for you.

Stop to dey take alcohol
Plenty people no dey like to hear say make them no take alcohol but the truth be say after you don take the alcohol finish, you go get fear for body pass before. So you need stop the alcohol take.

Spirituality
If you be spiritual person, you fit carry the fear mata go your spiritual battle ground go settle mata for there.

Medication
Medication dey help but most time, the help no dey last for long, e go just work for that period but for am to dey useful, you go add other things wey we don talk for up take join am. 

No comments:

Post a Comment