Wednesday, 22 April 2020

I Go Dye contribute him mansion to government as Isolation area

Francis Agoda wey him comedian name na I Go Dye don join pipo wey dey contribute to help government control and fight the spread of the virus COVID-19 for Lagos as the virus dey waka from one person to another and from one state to another through pipo them wey don dey infected with am.


I Go Dye say him won donate him mansion to the Federal government, make them use am as Isolation place wey them go take keep pipo wey don get the virus on till them don dey clean and release to go back to  their house. 

I Go Dye say him body dey pepper am too much as the number of pipo wey don get the virus take dey climb up every day for our country. That na wetin touch am say him go contribute him mansion join so government go use am as isolation place take treat pipo.  

Him even dey advice say make government ensure say pipo dem obey the stay for your house wey them say make pipo them do so that them go dey in control of the mata.



Na like this him take write am
"I'M  DONATING MY NEW FAPOH ROYAL SEAL MANSION TO FEDERAL GOVERNMENT OF NIGERIA TO USE IT AS AN ISOLATION CENTRE.

Humanity will overcome all its challengens only if we are willing to let  go of the things we are not using for now for the benifit of others.

In view of the increasing cases of #coronavirus patients in Nigeria, and  the few screening centres available for now, I'm deeply worried.
We will be making humanitarian sacrifices towards  contributing our selfless deeds to control the escalating records  of the #coronavirus as predicted by WHO.

According to I Go Dye, him say make government no take the virus mata play if dem won win the fight against the virus as the virus no get respect for any thing as him dey succeed pass areas when them block

Him say, him no think am 2 times to drop him FAPOH Royal Seal Mansion to the Federal Government make dem take use as isolation place take treat pipo wey don get the virus for body.

Him say, this na him own gift wey him fit give, we go speak for am for life till government them succeed find the solution to this virus mata wey they affect the country as a whole.

I Go Dye dey tell pipo wey dey nija say make them no dey play with the virus mata. Say the virus COVID-19 dey as e don kill over 1 million pipo them for the whole world

No comments:

Post a Comment